Good day my people,E dey sweet me as i dey write this post even with tired mode😩 This weekend go loud well well because my elder brother dey do im traditional wedding tomorrow, Saturday. As I dey type like this, house don already full with peopl, you know aunties, uncles, cousins, family friends everywhere just dey bubble.
Preparation don start since Thursday. Me I never rest. Na so so sweeping, cleaning, chairs and running errands all around. Even though e stress small, I dey enjoy am because na once in a while we dey gather like this. You know say Nigerian party no dey complete without long rice, jollof, small chops, drinks and gbedu wey go scatter everywhere.
Na long time I see some of my cousins and aunties wey dey stay for another state. As dem reach, we just dey catch up, dey gist about old times. Some even dey remind me of how I be small pikin wey dey always run up and down during family event. E sweet me for belle sha.
Tomorrow na the big day and everybody dey excited. The aso-ebi don ready, makeup artist go come early morning, . I even dey plan to help them coordinate food and drinks make sure say nobody complain say dem no chop or drink. I pray make God give me energy
After the whole party, I go come back here give una full gist on how everything go. From the bride outfit, the dance, the party cruise and maybe small drama (cos you know say Nigerian party dey always get one or two unexpected wahala 😅). But i pray say the party go dey sucessfull
So this weekend, I no go dey indoors at all. Na full-blown owanbe I dey go. E go be celebration of love, family and vibes. E go also give me time to breathe small from work stress and enjoy with people wey mean a lot to me.
Abeg make una wish my brother well as he begin this new chapter. And if una wan chop wedding rice, make una come sharp sharp before food finish o 😄.
How your own weekend dey look? Na rest you go rest or you get event like me? Share make we hear.
Thanks for stopping by and reading my post
Hamidu Yetunde🧡💜💛
Pictures are mine
Hmnnnn... Have fun and enjoy yourself
Thanks
[@PowerPaul:]
Hey! Because of your participation in the @CryptoCompany community and your participation in the "Banner for Boost" campaign you received a vote from your CryptoCompany and its trail! Thank you & Hive a great day!
Recent posting from @PowerPaul or the CryptoCompany network:
by @powerpaul
by @cryptocompany