I never really cared much about skincare before. As long as I bath and rub small cream, I think say I’m good. But joining Hive Korean Village really open my eyes. I start seeing plenty ladies with soft, smooth, glowing skin, and I keep asking myself, Abeg, wetin be their secret?" That’s how I enter into the world of K-Beauty
K-Beauty no be just beauty products o. It’s like a full skincare journey. Them dey take skin serious not by hiding pimples with makeup but by really treating and taking care of it from inside. The routine dey long sha cleansing two times, toner, essence, serum, sheet mask, eye cream, moisturiser and sunscreen but I still try am small small. I start with just cleanser, toner and moisturiser. Before I even add serum and mask, I don dey notice my face no dey dry again
One thing I like be say most K-Beauty products dey use natural ingredients like rice, ginseng, snail slime yes o, snail honey, green tea and many more. The first time I hear about snail I shock, but when I try am, it really help reduce my acne scars. I was surprised, my face become softer and clearer.
My best part na the sheet mask. That one dey sweet me pass. I just put am on my face, relax, sometimes play music or just lie down, and after 15:20 minutes, my skin go just dey glow anyhow. E be like say the mask dey pamper me. The best part be say K-Beauty no dey too expensive. With small money, you fit get good products that actually work.
Before K-Beauty, I dey rush my skincare, just wash and rub cream anyhow. But now I don learn say good skin needs time and gentleness. No be by scrubbing hard or using strong chemicals. K-Beauty teach me say I need to love and take care of my skin gently.
These days, I dey waka with natural face and people still dey compliment me I no dey wear makeup like before. Sometimes, na only sunscreen I rub and my skin go still dey shine. I no fit lie, this thing boost my confidence well well.
Joining Hive Korean Village help me a lot. I le
arn from other ladies product reviews, advice, and encouragement. We dey share our wins and even the mistakes. It makes everything easier and fun.
If you never try K-Beauty before, I go tell you make you try. Start small. Maybe just get cleanser and toner or one sheet mask and try am once or twice a week. Your skin go thank you. Me, I no dey regret. This K-Beauty life sweet me die
[@PowerPaul:]
Hey Belion! Because of your participation in the @CryptoCompany community and your participation in the "Banner for Boost" campaign you received a vote from your CryptoCompany and its trail! Thank you & Hive a great day!
by @powerpaul
by @powerpaul