You are viewing a single comment's thread:

RE: Hive-Naija Weekend Engagement #69- β€œTRUST ISSUES”

As @beckyroyal and @emreal dey tag me upandan, una no wan make this plan of spending the night at my bestie's place work ni? πŸ˜‚
Which kain monitoring spirits be this one na? πŸ˜‚.

We even plan to go to the movies from there we go hang out at one cool joint and then head home. We go come gist small, play hide and seek and throw pillows and then fall on each other while laughing. We'll then hit the bed and sleep soundly.

Ehen nau. What were you expecting? Oh, you think emotions go rise and we go chop the kpomo? No na, we're besties and besties don't do that. 🀣

Hehehe, story for the gods.

Since two adults of opposite gender, wey dey able and active, with fresh blood running through their veins go carry their short legs and clear eye dey do bestie bestie, to the extent of spending the night together, claiming nothing will happen in between. Issorite.

Me I believe them, nothing go happen na, besties don't do such things. πŸ˜‚ I hear you.

But you see that sleeping lion wey dem wan wake, make dem no run o when im finally wake. With their two korokoro eyes, they'll see that thing they're looking for.

No be for my mouth una go hear say Naija jaga jaga, everything scatter scatter . 🀣🀣

@ebonymama @bipolar95 @thelastdash, come chuk mouth for this matter.

0.00003555 BEE
2 comments

Hahahah mama, you don catch usπŸ˜‚ who be that bestie of yours? Na me go fry am, no talk say I no tell youπŸ˜‚

Say nothing go happen.. dey playπŸ˜‚ @dwixer come see wetin this my mom dey talk o

0.00000783 BEE

Wait, my baby don get bestie and I no know?

0.00000000 BEE

Ehen nau, nothing suppose happen. Na bestie code be that.

No be wetin dem dey talk.? πŸ˜‚

0.00000000 BEE
(edited)

Chai, my lawd, my fada, see my sis don land o with bomb for that matter.

Abeg chop knuckle 🀜🀜🀜

Man and woman dey do bestie, na ebe Keanu?

The beat they're playing, they must surely be ready to dance the dance too.

This your lion talk make me remember two funny songs if those days.

#1. Unleash the dragon by Sisqo

#2. Who let the dogs out by Baha men.

If you know this 2 songs, den you are qualified to eat at the elders table but if you don't know this 2 songs ehn, oya from now just dey call me Aunty Becky ASAPπŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

@rukkie, @kingsleyy do you know these songs

0.00000000 BEE

I no tok say make person no do bestie o, but my own be say, e no dey waste time for water to pass garri. To do bestie good o, but no carry fowl tempt dog, e nọ go chop am, crack the bone join. 🀣
Nonsense and ingredients
!BBH

0.00000000 BEE