You are viewing a single comment's thread:

RE: Hive-Naija Weekend Engagement #69- “TRUST ISSUES”

Una welldone o my people, Una doo.

My own be say I no talk say make my man no get woman or girl as friend but wetin go make me get wahala with am con show her small film for her be say make she no feel comfortable when I dey around abi make she no no her place.

SEBI nah she grew make dem introduce am as ordinary friend, even if them two dey do he no consign me, my own be say if I dey around my man make she shift go one side and if transformer dey, she fit hug am sha. This one make me remember one woman wey wan follow my husband by force dey call am friend dey chew gum the man up and down.

Na just my look pursue the were comot for my husband store me wey be say I be drama queen. The funny thing be say I no go even follow the woman talk, nah me with my man go do the talk. I the woman con put her mouth, she go collect. Ire o

0.00000000 BEE
1 comments

lol did your husband tell you anything about her!

0.00000000 BEE

Yes nah. Him tell me say babe see lagbaja o, nah computer she say she wan learn o but I no like as she dey touch me if anybody no and I no wan offend am

Na so I close from work one Friday go resume for him store, woo body tell the woman so they she stop work the following week con tell him neighbour wey con gist us later say me I get igba for head say shame dey catch her. The story long but make nobody bring shit come my domot