You are viewing a single comment's thread:

RE: Sam's Hangout #72- GENUINE CONNECTION ON HIVE

Me i went to church ooh, basically spent my whole day in church,@sam.hangout i saw your mention but was just calming down because wetin i learn full ground,me nah dedicated Christian πŸ€—

If you no go church come join sermon.

Topic: In Christ

Anchor scripture nah Matthew 16:15-18

Who Jesus really be na the koko of Christianity. If you dey see Jesus like ordinary man, or you no dey believe say na Him be the Christ, then you go miss the whole point of serving God
According to 1 Corinthians 5:16
We no dey reason people based on human level again, We don jam Christ, and that one don change our mindset, we no dey mix flesh and spirit again na Kingdom mentality we dey run with now.
If you still dey see yourself as ordinary, or dey limit yourself to human level, you go dey operate below your potential and nah you sabi bcos if anything do you no blame God ooh. Jesus no die make you remain like ordinary man,you gatz dey see yourself the way God see you.
The kind result wey you go see as Christian dey depend on your faith. If you believe say you no fit rise, you go remain down.
According to 1 John 5:1–4
Wetin dey overcome the world? Na our faith! No be by gra-gra, na by believing who you be in Christ.
Romans 6:6
Why God fit boldly talk say sin no get power over us again? Because Jesus don handle our sin matter. We don die with Christ, and we don rise with am,trust me sin no get level again.
2 Peter 1:3
God don give us everything we need to live this godly life,we no get excuse again. Christianity no be guesswork,na knowledge be the foundation and na why Hosea 4:6 talk say "My people perish because dem no get knowledge." If you no sabi who God be, and who you be in am, how you wan live like real Christian?

No let wetin devil dey do confuse you. E no be your standard.
The answer to sin na to get correct identity,you gats consciously put off the old man.
Ephesians 4:22
Remove the old character like cloth wey don dirty,na you go consciously do am, Christ don do him part go ooh.

Y'all make una come join service onlineπŸ˜‚πŸ˜‚
Tell me wetin you learn
@justfavour @rukkie @beckyroyal @merit.ahama @hopestylist @emlynx @kingdomzy @mathewdaddywah @nkemakonam89

0.00002349 BEE
4 comments

Wonderful. This is a lot for us to ponder on.
The purpose when Christ take come die for us na for us to get life in abundance and to cleanse our sins so we go get access to our father. He nor just come, he die and he come still rise from the grave. God don tell us say Jesus Christ na him pikin say make we listen to am. The question now na, who you dey listen to?

Thank you so much for sharing this message with us.

0E-8 BEE

Omo you carry your sermon come teach us here that is nice praise the lord

0E-8 BEE

My lawd 🀭🀭🀭🀭

0E-8 BEE

Omo, see correct preaching and in correct piddin too 😁

Really nice.

I learn say Jesus na oga. Jesus na my odeshi from all devil attack and na because of Jesus Christ I be God beloved pikin.

Chai, I Sabi book and I pay attention to the preaching.

0E-8 BEE